Omah Lay, Tems arrest in Uganda: Burna Boy, Laycon, Teni, Peter Okoye and odas react to Nigerian singer palava

Omah Lay and Ms Tems

Wia dis foto come from, Odas

Read am in 2 mins

Nigerian artistes and entertainers don begin raise voice in support of dia colleague Omah Lay, wey authorities hand cuff and remand for prison ontop accuse say e break dia Covid-19 rules.

Laycon, recent winner of di Big Brother Naija TV show, award winning musicians Teni, Sound Sultan, follow ask questions after Uganda Police charge Omah Lay, and two oda Nigerians wey go di East African kontri to perform for one concert.

Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openyi alias Tems and Muyiwa Awoniyi appear for Magistrate court on Monday 14 December ontop charge of "negligently doing acts wey fit spread infectious diseases".

"Why dem no shut down di [show] before e happun?," Laycon bin ask even as anoda Nigerian celebrity Sound Sultan para say na di promoters of di show Uganda authorities suppose dey face accuse.

Burna Boy, di two-time Grammy nominee sef chook mouth for di mata.

Omah Lay on Monday afternoon, post for Twitter wia e ask why Uganda goment dey use im mata take play politics.

Already, some pipo don dey call for Nigerian artistes to boycott di MTV Africa Music Awards (MAMA) wey suppose hold for Uganda capital Kampala in few months time.

Di singer blow for 2020 afta e release back to back hit songs, one of which na "Ye ye ye" and make Apple Music name im "Godly" song one of di most played for Nigeria.

See how Nigerians react

Burna Boy

Wia dis foto come from, Twitter / Burna Boy

Debo Macaroni

Wia dis foto come from, Twitter / Mr Macaroni

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Sound Sultan

Wia dis foto come from, Twitter / Sound Sultan

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Peter Okoye

Wia dis foto come from, Twitter / Peter Okoye

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3