You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Anele Ngcongca and Mshoza: South African, Genk football star die for car accident days afta ex according to reports - See wetin we know
Former South Africa midfielder Anele Ngongca die for car crash on Monday.
Di 33-year-old, wey play for Bafana Bafana during di 2010 World Cup, die at di scene of di accident as im bin dey drive between Johannesburg and Durban for South Africa.
Ngcongca bin dey travel to Durban to meet up wit im new AmaZulu team-mates, who im dey join on loan from Mamelodi Sundowns.
Im don help Sundowns win a third straight Premier Soccer League title last season.
Di two clubs release joint statement to confam di death and pay tribute to Ngcongca.
"AmaZulu and Mamelodi Sundowns FC extend dia deepest condolences to di Ngcongca family, former clubs, teammates, supporters and the broader football fraternity plus everybodi wey im don touch by di life of im exceptional football ambassador," di announcement tok.
Im career include nine years wit Belgian club Genk wia im make more dan 200 appearance, e spend im final season on loan for France wit Troyes.
He also play for di World Cup and im dey part of di Bafana Bafana team for di 2013 and 2015 Africa Cup of Nations finals.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di news of Anele dey come some days afta di death of ex-girlfriend, Mshoza.
According tori pipo for dispatchlive, Mshoza, die for one Johannesburg hospital from complications due to diabetes. Di two bin dey together for more than one year before di death.
Dem born Anele for October 21, 1987 for Cape town.
Details of Anele Ngcongca networth, house and cars no dey public and im no too dey active on social media.
Di defender win di 2010/2011 Jupiler Pro League, lift di Belgian Cup for 2009 plus di Belgian Supercup for 2011. He sign for Mamelodi Sundowns for 2016. Mamelodi Sundowns na di first professional team wey im don play for inside South Africa.