You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Elon Musk net worth 2020: Tesla automobile oga, CEO of SpaceX Elon Reeve Musk money
Elon Musk fit become di third richest pesin for di world as di stock of im electric-car dey increase.
Di share price of im Tesla electric cars don go up as much as 12 per cent to $460 (£347), wey make di electric car worth more than £320billion.
According to di Bloomberg Billionaires Index, dis share price fit make di 49-year-old business man climb di third place for di table of di world's richest people, above Facebook founder, mark Zuckerberg.
Di gain go make Musk net worth rise to $117.5 billion, as Zuckerberg still dey around $106 billion.
On Monday, dem name Musk electric automaker, Tesla, Inc. to dey part of di S&P 500 Index, and dis go make im shares go up.
Although, di company admission to di S&P 500 no go happun till Dec. 21.
Oga Musk wealth don jump from $90bn di year as di Tesla's share price continue to increase.
Im be Tesla largest individual shareholder, and Oracle CEO Larry Ellison dey follow am for back.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin you need know about Tesla?
Tesla Inc wey dem bin dey call Tesla motors na American electric motor company wey base for California.
Na electricity di motor dey use function instead of fuel.
Dem found di company for 2003 and afta 11 years Tesla become di number one selling plug-in and battery electric passenger car manufacturer for 2019.
Tesla cars account for 81% of di battery electric vehicles wey dem sell for di whole of United States for di first half of 2020.
Who be Elon Musk?
Born in South Africa, Elon Musk make more dan $160m from di sale of online payment service PayPal to eBay. Im desire to see humanity become true space-faring civilisation na di driving factor behind di founding of SpaceX. But he don also involve for di founding of oda companies like electric car manufacturer Tesla.
He also reason out di project, Hyperloop, one high-speed transportation system wey dey use pods wey dey travel through system of tubes. Im colourful personality and lifestyle make am di inspiration for Robert Downey Jr interpretation of Marvel Comics character Tony Stark.