You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Bashir El-rufai wedding: Kaduna state govnor i pikin don marry senator Kazaure pikin
Bashir El-rufai, di son of Kaduna State governor, don marry im wife, Kalima Kazaure, wey be di daughter of Senator Ibrahim Kazaure.
Di wedding happun on Sunday, October 21, 2020 for Nigeria capital, Abuja.
Plenty politicians including Nigeria Senate president, Ahmad Ibrahim Lawan, dey di wedding. Oda important person wey dey na di Governor of Kogi State, Alhaji Yahaya Bello; and Governor of Yobe State Mai Mala Buni.
Nigerians for social media don dey tok about di wedding since wen Bashir release some of im pre-wedding pishures wey cause kasala for Twitter.
According to some pipo wey react to di pishures, dem say e dey wrong for di bride to leave her hair open while odas also tok about how di govnor pikin grab im wife to be from behind.
Dis no be di first time wey Bashir dey see controversy on top Twitter, e get time wey e call former Ekiti govnor Ayo Fayose 'vagabond' wey some pipo see as lack of respect.
E also get time wey e throw shade to former vice president Atiku Abubakar pikin Mustapha because say im father tok say parents must teach dia children to respect women.
Di wedding go happun on Saturday, 21, November, 2020.
End of Di one wey oda users dey read well well
See some of di reactions
Who be Elrufai pikin wife to be?
Her name na Halima Nwakaego Kazaure and her father na from Kazaure local goment for Jigawa state wey dey northern Nigeria.
While her mother belong to di igbo tribe from south eastern part of Nigeria.
For one tweet wey she post on twitter, she say her mother na Igbo and her papa na Hausa but di most important tin be say she be Nigerian