Emmanuella house: 10-year old Mark angel comedy star tok about her mother new house and plans she get for her parents
Popular young Nigerian actor Emmanuella open up to BBC Pidgin about di house she build for her mama.
Di young comedian wey say e take her about a year to build di house say her mama deserve estate for everything she don do for her and say she still get oda ogbonge plans for her parents.
You fit like to read:
- Ooni of Ife and Olori Silekunola don welcome prince to di Oduduwa throne
- Husband 'cage' im wife for Delta state four years on accuse say she be witch
- Facts about Emmuanella wey you fit no sabi
- See Regina Daniel response to Ned Nwoko seventh wife tori
- Actor Williams Uchemba and Brunella Oscar traditional marriage tori, fotos and messages from celebs
More about Emmuanella
Her full name na Emmanuella Samuel, dem born her for July 22, 2010. She be 10 years old.
She be from Imo state, wey dey for di south east part of Nigeria.
For 2016, she collect award as di best new comedienne and princess of comedy for di Afro-Australia Music and Movie Awards for Australia.
Still for inside dat same year, she win award for Top Subscribed Creator from YouTube for di first edition of di Sub-Saharan African YouTube Awards.
Emmanuella Samuel, na child comedienne for Mark Angel YouTube channel wey get ova six million subscribers.
She become popular for her comedy skit "This Is Not My Real Face Oh".
She also get some endorsements for some big brands for di kontri.



