You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Samuel Eto'o Fils accident: Cameroon ex-football international survive car crash
Former Cameroon football international Samuel Eto'o Fils make accident but e dey fain according to family members.
Eto'o bi dey for Bafoussam for attend some festivals for weekend. E get di accident on e way back to Douala from di West region on Sunday.
But, close relations say de former striker dey fain.
De motor weh Eto'o bi dey inside scatter for front and e kombi dem say de accident bi serious.
Weti happen?
Security sources say driver for one travel agency cause de accident.
De driver hit two cars for Samuel Eto'o Fils e convoy.
Den, try for run, dey catch and take de driver for gendarmerie brigade for Nkongsamba.
Two motor, Prado, spoil-chakarah for front but no man get injury.
End of Di one wey oda users dey read well well
Eto'o cancel de complain wey e file for gendarmerie for seka say pesin no die.
De striker tell de driver say make e no di put e life and dat of passengers for danger, security officials tok.
Samuel dey fain
"Samuel dey fain, no worries, na only cars dem spoil", Wilfred De Happi, Eto'o e tok-tok pesin tell BBC News Pidgin.
E no answer any other kweshions.
Over 100 pipo di die every year for road accident for Cameroon seka bad roads.
But, for now, e no bi clear if e get injury or not, relations say e dey for hospital and doctors di check if e condition serious or not.