BBNaija 2020 housemate Nengi, Trikytee don become Bayelsa state Senior special assistants

Wia dis foto come from, Bayelsa State government
Former Big Brother Naija housemates, Nengi and Trikytee don collect appointment as Senior Special Assistant to Bayelsa State governor, Douye Diri.
Governor, Douye Diri, announces Nengi Rebecca Hampton wey come out as second runner-up for di reality TV show as face of Bayelsa Girl Child.
Di Bayelsa State governor say e dey proud of di housemates wey come from di State and advise her to continue to exhibit her humble and good characters for di house even in real life.
Nengi say she get passion to support girl child to di best of her ability and she wan also use her voice to fight gender based violence based on say she don experience am first hand.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Director/ Cordinator of New Media Bayelsa State Goment, Kola Oredipe say di Govnor also don appoint di oda BBNaija Lockdown housemate from Bayelsa, Tommy Sinclair, AKA Trickytee as im Senior Special Assistant SSA.
Though dem neva announce which portfolio Trikytee go hold.
Trikytee thank di Govnor of Bayelsa State say na big honor for am and im dey grateful for di appointment.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
How fans celebrate di news
Dia fellow former Big Brother Naija housemates and Fans of di reality TV show don enta social media to begin congratulate dem.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Twitter screenshot

Wia dis foto come from, Twitter screenshot

Wia dis foto come from, Twitter screenshot

Wia dis foto come from, Twitter screenshot

Wia dis foto come from, Twitter screenshot












