Laycon BBNaija win plus Nengi, Dorathy, Kiddwaya and oda housemates wey also pocket money at di end of di Big Brother Season 5 show

Finalist for Big Brother Naija

Wia dis foto come from, Big Brother Naija

No be new tori say Olamilekan Agbeleshe aka Laycon win BBNaija season 5 edition afta ten weeks for di lockdown house.

As winner of di show Laycon win prize wey worth 85 million naira. Inside di prize, 30 million cash, two bedroom house and motor dey inside.

But no be only Laycon win prize for di house. Oda housemates too win gifts and money for di different games wey See how much each BBNaija season 5 housemates win aside from Laycondem play for di house.

See wetin di oda housemates win:

Nengi

Nengi win prize from most of di challenges wey dem do for di house. She win N5,350,000 cash.

She also win food items for three months, homecare products for one year, box of skincare products, trips go Abuja and Scotland, Trip to Dubai for One Africa Music Fest and Bitcoin wey worth $500 plus including paint and ambassadorship.

Laycon

Laycon wey win Big Brother Naija dis year also gbab plenti money from competitions wey reach, N6,030,000.

E don also get marketing campaign deal, skincare products, free food, homecare products, ambassador deal, trip go Scotland and $500 Bitcoin.

Dorothy come second for di show.

Wia dis foto come from, BBNaija

Dorathy

Dorothy wey dey popular for house and dey friendly with almost all di housemates win N4,600,000.

She don also get new phone, paint, homecare products, free food, ambassador deal and $500 Bitcoin.

Neo

Neo prove say Warri no dey cari last as im don win for imself N4,054,000.

E also don win home appliance, free food, ambassador deal and $500 Bitcoin.

Vee

Vee comot di house with N6,170,000. Na she win di most money.

She also don get homecare products, free food, ambassadorship, trip go Scotland and $500 Bitcoin.

TrikyTee

  • Money im win: N4,055,000
  • Home appliance
  • Trip to Dubai for One Africa Music Fest
  • Paint
  • $500 Bitcoin

Ozo

  • Money im win: N3,494,000
  • Car
  • Trip to Abuja
  • $500 Bitcoin
  • Marketing Campaign
  • Trip to One Music Africa
Ebuka announce di winner for di show.

Wia dis foto come from, BBNaija

Prince

  • Money im win: N4,725,000
  • Home Appliance
  • Skincare product
  • Trip to Abuja
  • $500 Bitcoin
  • Trip to Dubai for One Africa Music Fest

Kiddwaya

  • Money im win: N2,461,000
  • New Phone
  • Paint
  • $500 Bitcoin

Wathoni

  • Money wey she win na N1,221,000
  • Skincare products
  • $500 Bitcoin

Brighto

  • Money wey im win: N1,679,000
  • Paint
  • $500 Bitcoin

Tolanibaj

  • Money she win: N845,000
  • Trip to Abuja
  • $500 Bitcoin

Praise

  • Money im win: N775,000
  • $500 Bitcoin
Laycon na di winner.

Wia dis foto come from, BBNaija

Lucy

  • Money she don win: N1,318,000
  • Paint
  • $500 Bitcoin

Kaisha

  • Money she don win: N472,000
  • Paint
  • $500 Bitcoin

Apart from all dis money, dem also win trips, influencer deals and oda gift items.