Police brutality in Nigeria: 'Di trauma wey I go through, I no fit explain am' - Tomori Emmanuel
Tomori Emmanuel na Graphics Editor for Lagos wey don share wit us di kain trauma wey im dey experience from wetin e call ‘failed justice system for Nigeria’.
Tomori wey tok say police shoot am for 2011, carry di matter go court afta e face plenti medical challenges.
E share wetin e take eyes see from di police, to medical sector and even reach court.
Video Journalist: Sarah Tiamiyu




