BET awards 2020 winners: Burna Boy 'Monsters You Made' performance & "BET Hip Hop Awards 2020 Winners" list

[Burna Boy] "Monsters You Made" performance & BET Hip Hop Awards 2020 Winners list

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

Burna Boy and Coldplay Chris Martin use dia powerful performance of "Monsters You Made" take pay tribute to victims of police brutality for Nigeria during di BET 2020 awards.

Artist like Rapsody, Master P, Megan Thee Stallion dey among who win di award

On Tuesday night October 27, Black Entertainment Television (BET) air dia everi year award show wey dey celebrate Hip Hop and dis year make am di number 15th.

Fans get di chance to see some of di biggest names for entertainment industry like; Lil Baby, City Girls, Burna Boy and Chris Martin perform dia hottest hits and win different category of awards.

[Burna Boy] "Monsters You Made" performance & BET Hip Hop Awards 2020 Winners list

Wia dis foto come from, ScreenShot

Wetin we call dis foto, Burna Boy "Monsters You Made" during di BET Hip Hop Awards 2020 on Tuesday night.

How Burna Boy perform "Monsters You Made"

Burna Boy and Coldplay Chris Martin use dia powerful performance of "Monsters You Made" take pay tribute to victims of di Special Anti-Robbery Squad (SARS) wey Nigeria goment don dissolve.

Burna Boy performe with full band as TV screen dey show civil rights marches for US and di protests inside Nigeria. Chris Martin suport am with im online performance.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

"Dis na for Tiamiyu Kazeem, dis na for Kolade Johnson, dis na for everyone wey lost dia lives for di hands of SARS and all kinds of police brutality. End police brutality now and end profiling." Burna Boy tok for di end of di performance as im and e band raise dia hand up.

BET also tweet say dem stand in solidarity with all those wey dey fight for justice inside Nigeria and add say "RIP to those wey don lost dia lives to di violence wey dey happen for Nigeria."

[Burna Boy] "Monsters You Made" performance & BET Hip Hop Awards 2020 Winners list

Wia dis foto come from, Screenshot

Wetin we call dis foto, Burna Boy "Monsters You Made"

BET Hip Hop Awards 2020 Winners

For di nominations, DaBaby lead with 12 nomination, while Roddy Ricch dey behind am with 11 and Drake plus Megan Thee Stallion get eight nomination. Here na di fulll list of winners;

Hip Hop Artist of di Year

  • Megan Thee Stallion

Best Hip Hop Video

  • Future f/ Drake, "Life Is Good"

Song of di Year

  • "The Box" (Roddy Ricch) Produced by 30 Roc & DatBoiSqueeze

Hip Hop Album of di Year

  • Roddy Ricch: Please Excuse Me For Being Antisocial

Best Collaboration

  • Megan Thee Stallion f/ BeyoncĂ©, "Savage" (Remix)

Best Duo/Group

  • Chris Brown and Young Thug

Best New Hip Hop Artist

  • Pop Smoke

Best Live Performer

  • Travis Scott

Lyricist of di Year

  • Rapsody

Video Director of di Year

  • Teyana "Spike Tee" Taylor

DJ of di Year

  • D-Nice

Producer of di Year

  • Hit-Boy

Hustler of di Year

  • Megan Thee Stallion

Best Hip Hop Platform

  • The Joe Budden Podcast

Sweet 16: Best Featured Verse

  • BeyoncĂ©, "Savage" (Remix) (Megan Thee Stallion f/ BeyoncĂ©)

Impact Track

  • Lil Baby: "The Bigger Picture"

Best International Flow

  • Stormzy (U.K.)

I Am Hip Hop Award

  • Master P