Ngozi Okonjo-Iweala win WTO Director General election? See latest from World Trade Organization

Ngozi Okonjo-Iweala win WTO

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, From all indication 104 countries including the EU and AU dey backing Ngozi Okonjo-Iweala

Dr. Ngozi Okonjo-Iweala of Nigeria get di best chance to get consensus to become World Trade Organizatio [WTO] Director General, WTO General Council Chair David Walker declare on Wednesday.

Nigeria candidate Ngozi Okonjo-Iweala vs South Korea trade minister Yoo Myung-hee race to become di first female Director General of World Trade Organization become very clear by 3pm Nigerian time Wednesday 28 October, 2020 afta one WTO General Council ordinary meeting for Geneva.

Tori be say one key group of WTO ambassadors don choose alias propose Ngozi Okonjo-Iweala to lead di World Trade Organization, according to wetin BBC find out from trade sources.

Based on informate wey BBC Pidgin don confam, dis one mean say di way don dey clear for madam Okonjo-Iweala to become di African to head di global trade watchdog in 25-year history.

From all indication 104 kontris including di EU and AU dey support Ngozi Okonjo-Iweala. Di official announcement bin dey expected afta di 3pm Lagos time (1400 GMT) meeting on Wednesday.

Before di meeting start Dr Okonjo-Iweala camp tell BBC on Wednesday afternoon say dem no fit comment immediately - dem dey expect a possible announcement by 5pm Nigerian time.

Wetin be di outcome of di 3PM meeting & wen dem go announce di new WTO Director General?

Ngozi Okonjo-Iweala win WTO

Wia dis foto come from, WTO

Wetin we call dis foto, Ngozi Okonjo-Iweala of Nigeria get di best chance to get consensus - WTO General Council chair tok afta di 3PM meeting for WTO Headquarters inside Geneva, Switzerland.

After di meeting WTO tok tok pesin Keith Rockwell summarize di announcement (wey land past 5PM Nigerian time) by di General Council (GC) Chair David Walker wey say:

"Di candidate wey get di best chance of attaining a general agreement alias consensus of di [WTO] membership na Dr. Ngozi Okonjo-Iweala of Nigeria. Consultations on di way forward go start immediately"

Di troika of WTO Ambassadors wey dey consult to choose di next DG of World Trade Organization [WT0] hope to get agreement alias consensus on a new DG wen General Council meet on Monday 9 November, 2020.

Ngozi Okonjo-Iweala camp tell BBC afta di meeting say Dr Okonjo-Iweala dey so humbled to receive di support of di WTO selection committee on Wednesday.

Wetin happun for World Trade Organization 3PM meeting?

BBC World Service Economics Correspondent Andrew Walker find out say:

Di process to decide di winner between Nigeria Ngozi Okonjo-Iweala and South Korea Yoo Myung-hee na di join bodi alias troika of member kontris dey lead am.

Na during dis period Ambassadors tell di rest of di members who dem think say be di candidate wey go most likely get general agreement alias consensus support as di next DG.

Ngozi Okonjo-Iweala win WTO Director General election?

Wia dis foto come from, Reuters/WTO

Wetin we call dis foto, Ngozi Okonjo and Yoo Myung-hee dey both contest to lead the WTO and di selection of a new director general of World Trade Organisation (WTO) dey final stage.

E go get some kain info wey dem go post for di WTO website afta di ordinary alias informal meeting (and trust BBC Pidgin say we go give you di authentic informate).

But e dey important to note say dis no go be di formal appointment as such.

Na di WTO General Council 9 November meeting go confam di final announcement.

Di aim of wetin happun during dis meeting na to get consensus - wey be say all kontris go at least dey willing to accept di candidate wey di Ambassadors propose.

So at dis stage constitutional right to reject a decision alias vetoes dey possible.

Wetin BBC Pidgin sabi be say US, wey dey support Yoo Myung-hee to be di next Director General of World Trade Organization, get veto power.

Ngozi Okonjo-Iweala win WTO Director General election?

Wia dis foto come from, State House

Wetin we call dis foto, Nigeria president Muhammadu Buhari say dem go do everitin possible to make Okonjo-Iweala win.

Madam Okonjo-Iweala bin work as two time Minister of Finance and then foreign minister for Nigeria. She bin also work with World Bank as managing director.

For how she dey ready to take on di role, she don tok for interview say "I be di only candidate wey dey work for di junction of trade and public health.

WTO reforms go tough but I don handle hard reform before plus including di reform of how kontris dey trade."

Details later...