Muhammadu Buhari: President Buhari confam say #EndSARS violence kill 69 afta "Lekki toll gate Lagos" shooting

Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, State House

President Muhammadu Buhari tell one extra-ordinary meeting wit all former Nigerian leaders say a total of 69 pipo na im dem kill inside di katakata across Nigeria.

Dem include 51 civilians, 11 police officers and seven sojas.

Wetin di president confam dey come afta more than 48 hours wen armed sojas open fire wit live bullets at unarmed #EndSARS protesters on Tuesday around 6:45pm for Lekki toll gate for Lagos.

Na di next day kasala wey turn heavy violence burst across di West African kontri.

Tori be say days of katakata wey start afta protests against police brutality don shake di kontri, wit serious destruction and tiff tiff and even killing join for plenti cities.

For di very difficult moment, President Buhari bin do meeting wit all former Nigerian presidents and military heads of state.

Di current high level of unemployment na danger for di kontri and goment gats tackle am to make sure say peace and stability dey di kontri.

President Buhari say im administration carry am for mind well-well to ansa all di tins wey di protesters dey clamour for.

Oga Buhari tok-tok pesin tell BBC say for di online meeting, say di presido say at least sixty-nine pipo bin die across Nigeria including eleven police officers and seven sojas.

E no dey clear yet weda di figures include protesters wey security forces allegedly kill on Tuesday for Lagos.

Di Nigerian army don deny say dia men fire di protesters.