You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
President Muhammadu Buhari order Nigeria security to stop violence
Nigeria President don direct security agencies to use any means wey dey for law book to stop di katakat alias violence wey dey happun across di kontri.
Buhari also order law enforcement agents to bring back law and order back for places wey dey experience choas for di kontri afta jaguda pipo hijact di EndSARS protest to end police brutality.
President, Muhammadu Buhari give di order on Thursday afternoon afta e preside over di National Security Council Meeting for Aso Rock Presidential villa, Abuja.
For nationwide broadcast wey Buhari do later on Thursday evening, di president say if anybody do anyhow to undermine di kontri national security, law and order im administration no go tolerate am.
Buhari beg all Nigerians to go about dia normal business and also ask security pipo make dem protect di lives and property of law abiding citizens.
Watch Buhari special broadcast on #EndSARS protests here:
Di Vice president, Secretary to di Goment of di Federation, Chief of Staff, Defence Minister, di Service Chiefs, IG of Police and oda heads of security agencies also attend di meeting.
Dis meeting dey follow days of violent protests wey don spoil plenti tins across di west African kontri.
Di Personal Assistant on New Media to president, Bashir Ahmad wey tweet dis informate add say;
End of Di one wey oda users dey read well well
"Hearts dey filled with emotions, sadness and grief for di events of di last 48hrs, may we never experience dis kain chaos."