Curfew: EndsSARS protests make Governor Fayemi order 24hr curfew for Ekiti State

Read am in 1 mins

EndsSARS protests wey jaguda pipo don hijack don make Governor Kayode Fayemi order 24hr curfew for Ekiti State.

Di 24-hour curfew go affect all parts of the State starting from 10.00 pm tonight, Tuesday 20 October, 2020.

Di goment of Ekiti State don observed with growing concern how di #ENDSARS protest, wey bin start as a peaceful protest against police brutality by youths in Ekiti State, don dey hijacked by some hoodlums, according to statement dem release on Tuesday evening.

Dis go make am three states; Lagos, Edo and Ekiti wey don impose 24hr curfew sake of di EndSARS protest palava across Nigeria.

Details later.