Sars Protest: What you need to know about States panel of inquiry into police brutality and extrajudicial killings

Wia dis foto come from, Nigeria Governors Forum
Lagos, Kaduna, Delta and Ekiti states governors don establish di Judicial Panel of Inquiry into Police Brutality and Extra judicial Killings wey go quickly look into all di cases, complain and accuse on top police brutality and make sure say any officer wey dey guilty face law and pipo wey deserve justice get am fast.
Dem set up di panel afta di directive wey Nigeria Vice President Professor Yemi Osinbajo give during di National Executive Council meeting wey e chair on Thursday 15 October, 20202.
Di Panels of Inquiry into Police Brutality and Extrajudicial Killings for each state go receive and investigate complaints of police brutality or accuse wey relate to say dem kill innocent person.
Di panel wey na retired High Court Judge go head wit oda members wey di state govnor select go look di evidence and check wetin happun, come decide wetin to do.
Na only four states out of di 36 states for di federation don set up dis Judicial panel for now.
LAGOS STATE

Wia dis foto come from, LAGOS STATE GOVT/TWITTER
Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu wey don come out to condemn police brutality, join di #ENDSARS protest even carry Lagos protesters demands go Abuja go give President Muhammadu Buhari don set up di Judicial Panel to torchlight SARS Brutality and Human Rights Violations.
Di orderly room trial of police officers start for Friday and he say some of di victims wey attend go testify before di panel next week.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di govnor also say im don arrange 200 million naira to compensate victims and officers wey shoot #ENDSARS protesters for Surulere don begin undergo trial.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
KADUNA STATE
Kaduna state goment for inside statement wey di Special Adviser to di govnor on Media and Communication, Muyiwa Adekeye sign tok say dem don appoint members of di judicial panel of inquiry into acts of police brutality for di state and go inaugurate am for Monday 19th October.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
DELTA STATE

Wia dis foto come from, TWITTER
Delta state govnor Dr Ifeanyi Okowa don approve di constitution of 8 man panel wey go shook eye into di complaints of police brutality and extra judicial killings for di state.
For inside statement wey di Secretary to di state goment sign, dem go inaugurate di panel on Monday 19th October.
EKITI STATE

Governor Kayode Fayemi of Ekiti state say im don set up di panel of inquiry wey go torchlight and look into inquiry and restitution for victims of SARS related abuses for di state.
ENUGU STATE

Wia dis foto come from, ENUGU GOV/FACEBOOK
Enugu state govnor Ifeanyi Okowa on Saturday 17 October announce say im go set up panel to investigate police brutality and extrajudicial killings for di state.
Di govnor wey tok dis one as im dey address di #ENDSARS protesters for di state also promise say im administration go establish human rights complaints teams of two and three pesins wey go dey receive complaints everyday.
He add say di team go dey established by di special committee on security and human rights.

Wia dis foto come from, TWITTER
Meanwhile on Wednesday, October 14, di Nigeria Govnors Forum meet wit di Inspector General of Police, Mohammed Adamu and say each state go set up panel for di compensation of all di victims of police brutality and make sure say dem give compensation to di pipo wey deserve am.
Di govnors pledge dia support to the kontri Inspector General of Police plan to reform police and make am more effective, accountable and transparent.
Dem add say e go fine if di IGP consult di public before dem take any decision. Therefore dem advice am to do meeting wit stakeholders to agree on format wey di reforms go take.
Many state govnors don condemn di police brutality and say dem go treat di issue wit urgency.
Meanwhile di #ENDSARS protest still dey go on for major cities for di kontri.















