You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
CSP James Nwafor: Governor Obiano sack former OC SARS, join Anambra protest against police brutality
Di governor of Amambra state South East Nigeria, Willie Obiano don sack James Nwafor, wey be former OC SARS for di state and promise say e go face di law.
Obiano announce di sacking of Nwafor wen e join young pipo wey dey protest against police brutality inside Anambra state and e no state di position wey Oga Nawfor dey occupy for im goment.
Di Governor say im feel honoured to stand for dia midst to share for dia feelings and e go make sure say dem prosecute James Nwafor even afta di sack.
"Today, I join youths of our dear State to say #EndPoliceBrutality and I support dem because dey no only vote and defend dia votes for my 21-over-21 victory but all dia requests dey genuine and important; and I grateful to honour dem all."
Di Governor go further to reveal three things wey im go do to help di youth and e include to secure di release of protesters, prosecute James Nwafor and odas;
"I feel honoured to dey dia midst to share for dia feelings; and I make am clear say:
- "First, Federal Government don disband SARS but I go personally visit all SARS offices inside Anambra State to make sure say dem release anyone wey dem arrest immediately."
- "Second, James Nwafor, former OC SARS in Anambra State is sacked and will be prosecuted;
- "Third, I go make sure say Presidency do di needful to make sure better life dey for our youths, for us, ndi Anambra and for our nation. Long Live Anambra Youths! Aluta continua!"
Outcome of Meeting Between Governor Obano and Nigerian Youths
To create more humane social order inside Anambra State, Governor Obiano decided to set up broad-based panel to look into reports of abuse of human rights by di former SARS inside di state ova di years and pesin wey go head am na Hon Justice V. N, Umeh, (retired). Di panel go complete dia job within 30 days. Members of di panels include:
- One Representative of di Association of Anambra State Students;
- Three youth leaders from di three senatorial zones inside di state;
- Member of di National Youth Service Corps inside di state;
- Anambra State chairman, Civil Liberties Organisation;
- Chairman, Anambra Civil Society Network;
- Chairman of di Youth Council of Nigeria, Anambra State Chapter;
- One representative of di Youth Wing of di Ohaneze NdIgbo, Anambra State;
- Chairman of di Youth Wing of di Anambra Town Unions (ASATU);
- Chairman of di Christian Association, Anambra State;
- One nominee of di Archbishop of di Anglican Province of di Niger;
- One nominee of di Archbishop of di Catholic Archdiocese of Onitsha;
- One representative of di Pentecostal Fellowship of Nigeria, Anambra State;
- One representative of di Chairman of di Anambra State Traditional Rulers Council;
- Di Attorney General & Commissioner for Justice;
- Di Commissioner for Youth & Creative Economy;
- Di two youngest members of di State Executive Council; and
- Di Special Adviser to di Governor on Creative Security.
Di governor say di panel go look, in particular, into di allegations of extrajudicial killings by former head of di SARS office inside di state, Chief Superintendent of Police James Nwafor (retired), wey dem don end im appointment as Special Assistant to di Governor since. E go face prosecution if dem find am guilty of any of di alleged offences.
End of Di one wey oda users dey read well well