SWAT police: See how new Special Weapons and Tactics team of police go work

Wia dis foto come from, NPF
Nigeria police say no member of di Special Anti-robbery Squad (SARS) team go dey di new Special Weapons and Tactics (SWAT) team wey dem lunch on Tuesday October 13.
Dem tok dis one as dem release new informate about di SWAT team wey go replace di SARS team wey dem ban.
Nigeria goment ban SARS afta widespread protest across di kontri by young pipo to end police brutality.
Five important facts about SWAT wey you suppose know
- No member of SARS team go dey di new SWAT tactical team
- Di work of di new Tactical team na to gada security informate
- Members of di new Tactical team no go do patrol work
- Members of di new Tactical team no dey allowed to search pipo phones, laptops and oda smart devices dem anyhow
- Pipo wey go dey dis new Tactical team must dey free of any criminal case especially those wey get to do wit touching or use of gun anyhow and abuse of human rights.
How di new SWAT team go work?
Di Nigeria Police also list four mandates or official order wey dem commission di new SWAT to do.
Di power wey di new SWAT team get include to:
- Respond to armed robbery attacks. Anywia wey robbery di happun, SWAT get authority to respond
- Di new tactical team get power to respond to any wia wey crime dey happun wit weapons
- Rescue operations na di number three mandate wey dem get
- Di last one na special operation wey involve high profile criminals
Dis mandate mean say from now on, dem no get any business wit checking pipo fone or laptop or motor or to enta pipo house witout any reason








