You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mt Kilimanjaro Fire: Africa tallest mountain dey burn - See wetin we sabi
Pipo for Tanzania still dey try quench di fire wey break out for di slopes of Mount Kilimanjaro, di highest mountain for Africa.
Members of di Tanzania National Parks Authority (Tanapa) and local pipo still dey to put out di fire wey start on Sunday.
Di height of di mountain, strong winds and dry weather cause di fire to spread fast.
E neva clear how di fire take start.
Tanapa share one foto wey no too clear of di fire for Twitter:
Wetin cause di fire?
E never clear yet.
Pascal Shelutete, one official from Tanapa, tell tori pipo, Reuters say "Di fire still dey go on and fire fighters from Tanapa, other goment institutions and locals dey continue dia effort to contain am,"
Di parks authority for inside statement tok say dem don take "every step to make sure say di fire no go affect di lives of tourists, dia equipment, porters and tour guides".
End of Di one wey oda users dey read well well
Mount Kilimanjaro, wey be 5,895m (19,341 feet) high na popular tourist destination and tens of thousands pipo dey climb am every year.