SARS: FG ban Nigeria Police SARS patrol immediately as Ughelli boil, #EndSarsNow #SarsBrutality top Nigeria latest news

Wia dis foto come from, TWITTER/NIGERIANHIVE
Nigeria Police SARS patrol dey banned wit immediate effect, federal goment announce on Sunday.
E follow plenti complaints wey many young Nigerians hala enta social media wit #EndSarsNow #SarsBrutality dey top Nigeria latest news about attacks and harassments dem dey suffer in di hands of SARS.
Nigeria police bin create SARS wey mean Special Anti Robbery Squad to fight armed robbery plus violent crimes across di kontri.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
One tweet wey di office of Nigeria president post on Sunday tok say Nigeria Inspector General of Police, Mohammed Adamu, don ban di staff of di Federal Special Anti-Robbery Squad (FSARS) plus oda tactical squads of di force from doing routine patrol wit immediate effect.
IGP Adamu give dis order afta investigate wey di leaders of di police do find out say some of dia staff dey hide under authority wey goment give dem to dia work, to do all kains of illegal tins wey dey against di Standard Operation Procedures, Code of Conduct and Rule of Engagement wey di squads suppose follow.

Wia dis foto come from, Nigeria Police Force
Apart from SARS, di oda tactical squads include di Special Tactical Squad (STS), Intelligence Response Team (IRT), Anti-Cultism Squad and oda Tactical Squads operating at the Federal, Zonal and Command levels.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
From now on, tactical squads no get right to do stop and search duties, checkpoints, mounting of roadblocks, traffic checks, etc.
Also, no police officer dey allowed to wear mufti go patrol or any tactical assignment. Dem must to show inside dia police uniform or any cloth or tactical gear wey dem approve.
End of Di one wey oda users dey read well well
How Ugheli boil sake of police brutality
Nigeria Police Force Special Anti-Robbery Squad bin come under attack on Saturday afta reports say some SARS operatives allegedly shot dead one young man in front of one hotel inside Ughelli area of Delta State, southern Nigeria.
Former Vice President, Atiku Abubakar, Minister of Youth and Sports Development, Sunday Dare, and rights group, Amnesty international dey among ogbonge voices wey don condemn di SARS brutality.
Tori be say one video wey turn viral on Saturday show how confusion and kasala burst around Wetland Hotel for Ughelli area where di policemen allegedly kill di victim, and escaped wit im vehicle - one white Lexus Sport Utility Vehicle.
By Sunday, Ugheli begin boil boil as different videos wey spread viral on social media show how boys begin protest wetin dem consider as Nigeria Police brutality.
But police for Delta State tell BBC Pidgin say di boy wey be di victim still dey alive.
No be SARS or FSARS outfit dey involved for dis case, na Operation Delta Safe na im handle dis particular mata for Ugheli, Festus Keyamo, SAN, Nigeria Minister of State, Labour and Employment (wey from Delta State).
Delta Police PRO Onome Umukoro tok to BBC Pidgin about wetin happun for the Ugheli.
Madam Umukoro say two guys wey bin dey inside di SUV and as dem see di police dem begin drive away wey come make di officers dey suspect something funny to pursue dem because e never too tay wen some jaguda pipo kidnap one woman and her pikin for dat Ughelli using Mercedes-Benz car.
"So wen di police catch dem, one of di two pipo wey dem arrest jump out of di moving motor wey make im get injury for im head and body so wen di police try to rescue am, angry mob come out so dem come comot for di area to avoid violent confrontation." Umukoro add.
Di police PRO say immediately, dem deploy di divisional team and di tactical team patrol men to go di scene and na dia dem tell dem tell dem say dem don cari di man go hospital for treatment and right now di man dey respond well to treatment.
"But di oda pesin for di vehicle dey wit us." She tok.














