Dissolved SARS: Nigeria police dissolve [SARS] - See four oda times IGP ban dem sake of #EndSARS palava

Dissolved SARS: Nigeria police dissolve [SARS]

Wia dis foto come from, NPF

Read am in 3 mins

Nigeria Inspector-General of Police, Mohammed Adamu, today announce say dem don dissolve di Special Anti-Robbery Squad afta five days of non-stop #Endsars protest wey Nigerian youths do.

Before oga Adamu dissolve SARS today, im don first bin ban dem several times sake of di complains from citizens on top how officers from SARS dey maltreat pipo.

BBC Pidgin don gather di oda times wen Nigeria central goment (Federal Goment) ban or restrict Nigeria Police SARS operations just for you to sabi say no be today.

Ban on top protest of Police brutality

On 4 October, 2020 di Inspector General of Nigeria Police Mohammed Adamu on Sunday announce di ban on tactical squads like FSARS make dem no dey go on patrols again or do stop and search but dat one no be news again because e don happun again and again and notin change.

EndSARS: Nigeria Police SARS
Wetin we call dis foto, SARS men for Lagos on Monday April 1, 2019

IGP close down SARS satellite offices

For February 2020, afta di death of one Remo stars player, Tiamiyu Kazeem, di IGP Mohammed Adamu order say make dem close up all di satellite offices of SARS for di kontri.

In fact sef , na di Deputy Inspector General of Police in charge of Criminal Investigations Department, Peter Ogunyonwo tok dis one even as im go for condolence visit to di parents of Tiyamiyu Kazeem inside Sagamu wey die for police hand early dis year.

Oga Adamu describe di satellite offices wey di Assistants-Inspector General of Police (AIGs) establish as mistake.

Disband FSARS

For January 2019, di current IGP wey be Acting Inspector General of Police of Nigeria Mohammed Adamu disband Federal SARS, Special Investigation Panel and Special Tactical Squad with immediate effect (dis na repeat of wetin im do for October 2020).

Oga Adamu bin give order to state Commissioners of Police say make dem oversee di disbandment.

Nigeria Police

Wia dis foto come from, YASUYOSHI CHIBA

Wetin we call dis foto, SARS na special anti-robbery squad of Nigeria Police and for 2018 dem enta news wella because of how dem dey take do tins. Some Nigerians enta street protest and even create di #EndSARS campaign, unto how dem say di police unit dey take treat especially young pipo.

E tok for meeting with di commissioners say, "Wit immediate effect, all di Commissioners of Police for each of di 36 police command plus FCT suppose take full control of all SARS operation for dia command.

While di one for di headquarters go dey under di control of di DIG, Force Criminal Investigation and Intelligence Department, FCIID", IGP Adamu add dat time.

EndSARS: Nigeria Police SARS

Wia dis foto come from, Remo Stars/Police

Wetin we call dis foto, Inspector General of Police Mohammed Adamu (left), late Remo Stars footballer Tiyamiyu Kazeem (right)

Di Introduction of F-SARS

For August 2018, Nigeria Police put out statement on how di new F-SARS no go dey do stop and search for road.

Dem bin promise dat time say, "na now dem don begin go back to di way tins suppose be. Police suppose be friends wit pipo wey dem dey police. If police mess up now, e no go reach 24 hours before im go face di law."

But anytin change? For where.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Ban of unnecessary stop and search for 2017

For 2017, former Inspector General of Police Ibrahim Idris put ban on stop and search wey dey unnecessary.

Di IGP dat time tok say everi officer wey dey work must dey dia full uniform and identification or dem go enta serious trouble.

SARS picture

Wia dis foto come from, Police

Nigeria police bin create Special Anti Robbery Squad to fight armed robbery plus violent crimes.