Precious Chikwendu: Femi Fani Kayode confam separation from wife inside response to allegations of abuse for im marriage

Wia dis foto come from, INSTAGRAM/@REAL_FFK
One of Nigeria former Aviation Ministers, Femi Fani-Kayode wit im wife cari di drama around di marriage enta social media.
Inside one tweet wey Oga Fani-Kayode bin use respond to allegations of abuse, e label im wife Precious Chikwendu as "estranged", wey mean to separate or say closeness no dey again.
Di drama bin first start when Sahara reporters release one viral video of madam Precious and her husband dey exchange words.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
For series of Tweets wey di former minister post for Saturday evening, e tok say no truth dey inside di video wey di online paper post. He say "I no physical abuse, I just collect phone from her make she stop to dey record me".

Wia dis foto come from, Precious Chikwendu/TWITTER
Fani Kayode say im neva physically abuse im wife before.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Tori bin comot earlier say former minister and im wife don separate. Di blog Stella Dimokokorkus wey publish di informate say di separation na sake of serious domestic violence.
Part of wetin di blog write na say tori be say Precious move comot di house four months ago without her four sons she get with Fani-Kayode as di former minister forbid her to near di house.
Di tori also say Fani-Kayode collect back di car gift and oda tins e buy for her wen dem dey togeda. Di blog also allege say Precious chop beatings plenti times, even wen she dey pregnant for her first son and di triplets.
End of Di one wey oda users dey read well well
But lawyers of Fani Kayode wey write letter give di blog deny all di accusation.












