Nigeria petrol / electricity: Lai Mohammed on how strike go cause more hardship for Nigerians

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Nigeria minister for information Lai Mohammed don beg di kontri workers make dem no do di strike action wey dem plan to start next week, say di strike go cause more affect di citizens.
Oga Mohammed tell tori pipo for Lagos on Saturday say make Nigerians dey patient wit president Buhari goment say better days dey ahead.
Workers dey prepare to start strike action plus protest on Monday 28 September sake of how goment increase of petrol price and electricity money happen for di same time all over di kontri.
Meanwhile di minister counter for one statement im release say di price of petrol for Nigeria na di lowest among kontris we dey around for west Africa.
E say di increase in petrol and electricity price wey happun di same time na "mere coincidence".
According to im breakdown, dis na how petrol dey sell for some African kontries compared to Nigeria.
- Nigeria - 162 Naira per litre
- Ghana - 332 Naira per litre
- Benin - 359 Naira per litre
- Togo - 300 Naira per litre
- Niger - 346 Naira per litre
- Chad - 366 Naira per litre
- Cameroon - 449 Naira per litre
- Burkina Faso - 433 Naira per Litre
- Mali - 476 Naira per litre
- Liberia - 257 Naira per litre
- Sierra Leone - 281 Naira per litre
- Guinea - 363 Naira per litre
- Senegal - 549 Naira per litre
Di ministers also tok say Nigeria electricity tariff follow for di lowest among some African kontires
- Nigeria 49.75
- Senegal 71.17
- Guinea 41.36
- Sierra Leone 106.02
- Liberia 206.01
- Niger 59.28
- Mali 88.23
- Burkina Faso 85.09
- Togo 79.88
Koko be say di kontri goment and di workers don dey do tok-tok since di new price come into effect, but e never get head. Na im make di workers dey insist say dem go begin strike on Monday if goment no reduce di price hike.
End of Di one wey oda users dey read well well
Local tori pipo dey report say goment don collect fresh court order wey dey restrict di workers from going to strike, although organised Labour never react to dis.















