Abule Ado blast: Wetin cause di explosion wey destroy one girls school for Lagos

Wetin we call dis Video, Abule Ado blast: Di explosion wey destroy one Nigerian girls school

One explosion for Lagos, Nigeria shake di city well-well. Twenty-three pipo die and e totally destroy one girl’s school.

Di Nigerian National Petroleum Corporation, di kontri oil firm, say na truck wey hit gas cylinders near one of e pipelines naim cause di blast for March.

But BBC Africa Eyes investigation show say dis explanation for di cause of di blast, wey destroy over 100,000 square metres of di city, dey wrong.