Emir of Zazzau: Shehu Idris di Emir of Zaria don die

...

Wia dis foto come from, EVENTS UNLIMITED PHOTOGRAPHY

Read am in 1 mins

Reports from Kaduna state for northern Nigeria dey tok say di long serving Emir of Zaria Shehu Idris don die.

Di Emir die on Sunday morning after spending 45 years on di throne wey e mount on February 16th 1975.

One of di chiefs for di Zazzau Emirate and son of di late Emir Bashir Shehu Idris na im confam di news to BBC.

Some reports tok say di emir die after two weeks of illness wey see am get admission for one hospital for Kaduna state.

Di late Emir na of di oldest for northern Nigeria and e die at the age of 84.

Govnor of Kaduna state Mallam Nasir El-Rufai don send im condolence message via Twitter.

"I dey sad to announce di death of father of our state, his highness Emir of Zazzau Shehu Idris, e die for 44 Hospital in kaduna after brief illness." Part of im message read.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post