You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
PlayStation 5 price: Nigerians search for wia to buy Sony latest game
Game lovers across di world don dey find wia to pre-order di latest Play Station 5 afta Sony release am on 12 November.
Sony announce say di video game console go cost $499.99 but di digital model, without disc drive, go also dey available wit starting price of $399.99.
Online stores like Target and Best Buy already don place pages wia pesin fit sign up for notifications once di consoles and gear dey available for pre-order.
Walmart no even wait for di preorder date of 17 September. Dem Tweet yesterday say make pipo start to dey 'pre-order now.'
Sony bin don first sama warning say e fit dey challenging to pre-purchase PS5 sake of high demand and low supply.
Wia to pre-order di new Playstation 5:
Walmart
GameStop
Amazon
End of Di one wey oda users dey read well well
Target
Dis price don put Sony up against Microsoft next-gen consoles wit Xbox Series S wey start at $299 and Xbox Series X for $499 on 10 November.
During one livestream showcase wey Sony do for 16 September, dem play different trailers of new games wey dey come to di PS5 wey include:
- God of War
- Ragnarok
- Final Fantasy 16
- Hogwarts Legacy
- Call of Duty Black Ops
- Cold War and PS5 exclusive Marvel Spider-Man: Miles Morales.