You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Pastor Chris Oyakhilome rapture prediction and breakdown of wen e fit happun dey make pipo tok
Founder of Loveworld Ministries a.k.a Christ Embassy, Pastor Chris Oyakhilome don 'predict' wen rapture go happun.
According to di pastor, time don near very well and pipo need to prepare.
For one of im sunday service , he explain to im members how much time dem get before rapture happun and why dem need to dey ready.
"If e bin say 3000 years we go know say we get 1000 years more to go, if im bin say na 2500 years we for sabi say we get more time to go, how close we get, make I show una di timeline and just explain three options."
"Remember di rapture itself no get sign, in other words e fit happpun anytime, anytime, but we get one final place beyond wia e no fit go." he add.
E show dem im church members di chart wey im don use calculate am.
For inside di chart, e say im use di range of di time wey Jesus waka comot di temple as 30AD and wen dem born am within 4BC to 2BC to take calculate wen rapture go happun again.
"If we just dey take an average of 30AD plus 2000 years from dia, we go enta year 2030."
End of Di one wey oda users dey read well well
"From 2020 to 2030, na 10 years and e mean say e no go pass 10 years before di man of sin go dey revealed," Pastor Chris tok.
See di three options Pastor Chris predict
Pastor Chris explain say na along di line of three options 'Jesus second coming' go happun.
"Seven years either after or within or across, if na afta, before e come back go be seven plus ten, dat na 17 years before Jesus come back, seven for di tribulations and 10 years before di antichrist shows up if na afta, if na inside you get three years before e show up, if na across you get six and a half years before e show up but because six months don pass for 2020, dat mean say you get six years remaining.
"E mean say e if e no happun in three, e fit be six, if e no happun in six e no fit pass 10." Pastor Chris tok.
How pipo react to di prediction?
Pipo don enta social media to tok dia mind as to wetin dem think about di mata.
Pastor Chris add say scientist too sabi wetin go happun naim make dem dey tok say by di year 2030 dem must put vaccine on everybody for di world and put chip on dem.
"2030 na di goal by GAVi and MIT, thik about am…Even Satan don dey try to understand di scripture and e dey push im pipo to act. So dem get a goal." He add.