You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Donald Trump get 2021 Nobel Peace Prize nomination - See wetin we know about am and how di committee dey select dia winner
Just some weeks afta Donald Trump help settle di quanta wey dey between Israel and the United Arab Emirates (UAE), one Norwegian lawmaker don nominate di American president for di 2021 Nobel Peace Prize.
Tori pipo for Fox news report am say Norwegian Parliament member, Christian Tybring-Gjedde, bin submit di nomination sake of Trump efforts to settle some conflicts worldwide.
"For im merit, I think im don try to create peace between nations dan most oda Peace Prize nominees," Tybring-Gjedde, one four-term member of Parliament wey also serve as chairman of di Norwegian delegation to di NATO Parliamentary Assembly, tell Fox News for one exclusive interview.
Tybring-Gjedde, for im nomination letter to di Nobel Committee, say di Trump administration don play ogbonge role for di establishment of relations between Israel and di UAE.
How dem dey nominate for Nobel Peace Prize?
For informate ontop di Nobel committee website, anybody wey meet di nomination criteria fit nominate pesin for di Nobel Peace Prize
Dem no need get or send letter of invitation to submit and na until 50 years later before dem reveal di name of di nominees and oda informate about dem.
Afta dem don investigate all di nomination list to make sure say di pesin wey dem nominate meet all di criteria, di Norwegian Nobel Committee go select di Nobel Peace Prize Laureates.
How dem dey select Peace Prize Laureates?
Di Norwegian Nobel Committee na im dey responsible for di selection of eligible candidates and di choice of di Nobel Peace Prize Laureates.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Committee get five members wey di Norwegian parliament appoint.
Na for Oslo, Norway, dem dey give di Nobel Peace Prize
Na for Stockholm, Sweden, dem dey hand ova di Nobel Prizes for Physics, Chemistry, Physiology or Medicine, Literature and di Economics
How Trump broker peace israel and UAE?
President Trump on 13 August 2020, bin announce wetin he call "Historic Peace Agreement" between Israel and di United Arab Emirates. he tok say dem agree to "full normalization of relations."
For inside statement dem tok say di "diplomatic breakthrough" na at "di request of President Trump," and say Israel go "suspend to dey declare sovereignty ova areas wey dem mark for di President Vision for Peace and focus dia efforts now on expanding ties wit other kontris for di Arab and Muslim world."
Earlier dis year, President Trump bin tok say dem overlook am for 2019 Nobel Peace Prize afta dem give Ethiopian Prime Minister, Abiy Ahmed, peace prize sake of how im settle border conflict wit Eritrea.
Na di Nobel Peace Prize committee go determine whether President Donald Trump go win di 2021 award or not.