Penis Captivus: Medical expert explain wetin fit make man and woman hook during sex

Awọn ololufẹ meji lori ibusun

Wia dis foto come from, Getty Images

Medical expert don explain wetin fit make man and woman hook during sexual intercourse.

Dis na afta di recent viral video of one man and woman wey glue togeda as dem bin dey knack for Ogun State, Southwest, Nigeria wey come make some Nigerians dey hala say na 'Magun' .

Magun according to di Yoruba believe na one ogbonge charm to stop women from cheating on dia partners and dem dey refer to Magun as 'Thunderbolt.' If di woman cheat with any oda man apart of her partner, two of dem go gum togeda.

But Dr John Dean, wey be senior UK-based sexual physician, say dis na wetin doctors dey call Penis Captivus (captive penis).

"Wen di penis dey inside di vagina, e go come swell up well-well," e tok as e dey give im hypothesis of wetin dey cause di problem.

"Di muscles of di woman pelvic floor go contract during orgasm. While those muscles dey contract di penis go come dey stuck inside and swell up di more."

Finally di vaginal muscles go come relax, di blood wey make di penis bin swell up well-well go come flow out and di man go come fit withdraw.

Dr Dean say several of im patients don discuss with am about dia experience of getting stuck during sex ova di years.

Oda explanation on top penis captivus

couple inside bed

Wia dis foto come from, Getty Images

According to health line, for penis captivus to happun, series of events during sex must take place.

Di penis, wey dey fill with blood during erection, fit continue to grow in size before orgasm. Den di vagina walls, wey dey made of muscular tissue, go dey expand and contract during sex.

Di muscles inside di vagina fit vibrate small during orgasm, too.

On some occasion, di vaginal muscles fit contract more dan normal. Dis contractions fit narrow di vaginal opening. Dis narrowing fit prevent di man from removing im penis, especially if e still swell and erect.

Awọn ololufẹ meji lori ibusun

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin to do if you get penis captivus

Di important thing to do if you find yourself inside dis condition na to stay calm, exercise patience and wait.

Dr Dean say afta some time, di vaginal muscles go relax, di blood wey make di penis bin swell up well-well go come flow out and di man go come fit withdraw.

E compare penis captivus to di common and serious condition of vaginismus - dat na di condition wey woman vaginal muscles dey contract or squeeze on e own wey something like tampon or penis enta.

According to Health Line, after orgasm, di vaginal muscles go begin to relax. If di man also reach orgasm, di blood go begin to drain from im penis, and di erection go ease. You fit dey able to remove di penis from di vagina.

Wetin be Yoruba believe about 'Magun'

One woman from di Yoruba community wey follow BBC Pidgin tok but no gree make we call her name say 'Magun' dey real and na traditional means to guard women and men from cheating on dia partners.

She say na juju wey dem dey do for di woman body and she go transfer am to any man wey get illicit affairs with her. Dem dey use tiny broom to prepare di 'Magun', then place am for floor and di woman go come cross ova am without knowing.

E add pipo wey suspect say dia partner dey cheat on dem dey use 'Magun' to catch dem and na different kind of 'Magun dey;

  • Hook type Magun - Dis na di common one wey di man and women wey dey cheat on dia partners go hook togeda during knacking.
  • Taste for water type of Magun - Dis na di 'Magun' wey di man go dey look for water to drink afta e knack woman wey get Magun for body, e go fit even fit finish drum of water and e belle go come full until e die.
  • Summersault type of Magun - Dis na wen di man go summersault three times before e die afta e sleep with di woman wey get 'Magun' for body.
  • Egg Magun - Dis man go dey look for egg afta im don do kerewa finish with woman wey get 'Magun'.

She add say most times di women no dey know say dia partner use Magun for dem until dem hook with dia cheating partner.