BBNaija: Erica say she no hate Laycon - See oda tins di Big Brother Naija ex-housemate tok afta her disqualification

Big Brother disqualified housemate, Erica Ngozi Nlewedim don come out tok for di first time afta organizers of di show disqualify her.

Erica apologize give everybody wey dey watch di show, all her supporters, fans, my family and friends, then add say she no hate Laycon

"I don apologize give di housemates before I leave di house and I go like to apologize to everybody wey dey watch di show, all my supporters, fans, my family and friends, I dey very sorry for my actions

"And I dey very sorry for saying those horrible words to Laycon. Laycon I no hate you, we get our disagreement but I no hate you. And to everybody wey I insult, Dorathy, Prince and all, I dey very-very sorry."

Erica address her quanta with Laycon

Erica don address wetin go wrong with her relationship with Laycon wey be her padi-padi before for di lockdown house.

"I think na wen e start to dey tell pipo say I try to kiss am. To my knowledge di kiss only happun once and I dey drunk dat time. E know say if not for di alcohol, e for no happun in di first place. "

And e lie say I try to kiss am some other times. Once no be plenti times and e decide say e no wan tok to me anymore, so I dey wonder why e continue to dey about me to different pipo and making me look bad. "

Ngozi Nlewedim add say she think say di quarrel between her and Laycon fit dey settled because she no even get any negative feelings towards Laycon.

"One thing about me, whenever I dey vex, I just want to tell di pesin how I feel and within a few minutes e don dey ova and I think I don do dis ova and ova. so I no get any grudges against Laycon."

Oda things wey Erica address for di Interview

  • Erica tok during her interview say afta her disqualification she feel relieve and happy to dey outside.

"I dey happy to see my loved ones and my supporters, I really need dis, so I dey happy to dey outside di house."

  • Erica say di lesson wey she don learn from staying inside di house be say she need to dey fine with being alone.

"I noticed that I no dey fine being alone but now I know say I need to dey fine been on my own."

  • Erica say her favourite moment for di house na wen she win di head house two times and di parties

"I really like having fun, dancing, dressing up, looking pretty, task and all di challenges, I love winning."

  • Erica say wetin draw her to Kiddwaya be say she feel like dem get some similarities.

"Both of us dey carefree, we both dey crazy and kind of complete babies too and our conversations just dey flow naturally, we dey very cool."

  • Erica say she no feel say Kiddwaya feel di same way about her but she no really care about dat.
  • Erica say she think Kiddwaya play a role for di strikes wey she get but na still her responsibility and she feel like she also play a role for di strikes wey Kidd get
  • Erica say wetin she go miss about di house na not paying any bill and dey chop free food all di time. She add say she go also miss di competition as di task na fun.
  • Erica say di first thing she go like to do wen she go back to her normal life, na to tok to her loved ones as she don really miss dem and really need dia support.
  • Erica say as she don dey through with Big Brother, di venture wey she go like to go into na my acting, she go like be brand ambassador for numerous brand, go into real estate and beauty business