Alopecia: Jasmine Ogunbodede say "some say I be ‘ogbanje’ na why I no get hair"

Wetin we call dis Video, Alopecia: ’Some say I be ‘ogbanje’ na why I no get hair’ - Jasmine

Video Producer: Sarah Tiamiyu

Jasmine Ogunbodede get medical condition wey dem dey call ‘Alopecia Totalis’ wey mean complete baldness.

‘Na wen I dey final year for university naim I start to dey loose my hair’ na wetin Jasmine tok as she tell us how her wedding no happun sake of fear of di ‘unknown’.

As September be Alopecia Awareness Month, Jasmine dey raise her voice tok say she no be her hair, she dey bold, beautiful and she no be anybodi else.

Jasmine start her foundation wey she call Heroic Alopecia Foundation five years ago to create awareness for alopecia and di foundation don get about 15 oda women wey also get oda types of alopecia.

All dis women inside dis video wan make pipo dey aware, make dem stop di stigma and make dem show love to evri pesin wey get alopecia.

Dr. Shakirat Gold-Olufadi wey be Consultant Physician and Dermatologist for University College Hospital, Ibadan tok say ’alopecia na medical term for hair loss and e get plenty tins wey dey cause am’.