'I no know say I different for society until pipo begin look me one kain'
Meet Jennifer Nikoro Oghenewaire, di legal practitioner, administrator and councillor.
Di woman wey come from Delta state for South -south get one hand. She tell BBC Pidgin say dem born her without one complete hand.
But she no allow her disability affect her dreams.
Oghenewaire share her journey into Law and how she dey motivate herself and oda pipo wey dey disable like her.

