You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ecowas meeting for Niger: Buhari agenda for di summit include Covid 19, terrorism and single currency mata
For di one day summit, oga Buhari go present im special report on covid 19 to oda leaders from west Africa.
Dis na sake of say di regional body appoint am as di champion to fight Covid 19 for April during one of dia Extraordinary Virtual summit and im role na to epp coordinate how kontris for West Africa go take fight di disease.
Nigerian presido Muhammadu Buhari dey fly go Niamey, Niger Republic to participate for di 57th Ordinary Session of di ECOWAS Authority of Heads of State and Government.
For statement wey presido tok tok pesin, Garba Shehu release, im say for inside di summit, dem go also chook mouth on top di Ecowas single currency programme and na president Julius Maada Bio of sierra Leone go present di special report.
Oga Bio wey be di chairmo of ecowas leader dem on top West Africa monetary zone go do im presentation along side president Alassane Ouattara of Ivory coast wey be chair of West African Economic Monetary Union (WAEMU/UEMOA).
Oda important tin wey go dey table for discussion na Ecowas vision 2050. Presido of Ecowas commission Jean Claude Kassi Brou go present to di West African leaders, the 2020 Interim Report on di activities of di sub-regional body including ECOWAS Vision 2050.
Anoda important tok for di meeting go be di high number of cases of terrorism, insurgency, armed banditry and piracy for di region.
Also di recent political gbege wey happun for Mali and di way di military dem scata democracy for di kontri go also gain attention.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di West African leader go also chook mouth for di up coming election presidential and parliamentary election for Burkina Faso, Cote d'Ivoire, Ghana, Guinea and Niger.
Dem go agree and torchlight di need for di elections make dem dey free fair and credible plus ensure say no political kata-kata happun for those kontris dem.
Oga Shehu say president Buhari go fly go di meeting wit oda top goment officials plus ministers dem and dem go return back to Abuja, Nigerian capital afta di meeting.