You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Russia Covid-19 vaccine: Nigeria wan torchlight 'Sputnik V' vaccine wey President Puttin approve to treat coronavirus
Nigeria goment announce on Friday say dem dey torchlight Russia COVID-19 vaccine.
Russia Ambassador to Nigeria, Alexey Shebarshin, bin do meeting wit di Minister of Health, Osagie Ehanire, wen im visit di ministry for Abuja.
For inside Tweet di ministry say "dem dey check di drug, di treatment and how e dey work".
Dat na why we dey show interest for di covid-19 vaccine so dat we go get di opportunity to check am well-well.
Wetin we know about Russia 'Sputnik V' corona vaccine
Russian goment bin announce say dem go begin mass vaccinations against coronavirus for October.
Russian scientists tok say early-stage trials of di vaccine don dey complete and di results na success.
Dr Adepimpe Adebiyi wey be Director Hospital Services Department tok say dis na opportunity to expand our vaccine production.
Di Russian vaccine use adapted strains of di adenovirus, one virus wey dey usually cause di common cold, to trigger immune response.
End of Di one wey oda users dey read well well
But di vaccine approval by Russian regulators happun before dem complete di ogbonge study wey suppose involve thousands of pipo, wey dem call di phase-three trial. Experts dey consider dis phase as important part of di testing process.
Upon dis, Russian Health Minister Mikhail Murashko tok on Tuesday say di vaccine don "prove to dey highly effective and safe", e hail di vaccine discovery as big step toward "humankind victory" ova Covid-19.
Presently Russian vaccine no dey among World Health Organization (WHO) list of six vaccines wey don reach phase three clinical trials, wey involve more widespread testing in humans.