Shinzo Abe: Japanese prime minister dey ready to resign because of health

Shinzo Abe

Wia dis foto come from, Getty Images

Local tori pipo dey report say Japan Prime Minister Shinzo Abe wan resign from office sake of health reasons.

E don dey suffer from ulcerative colitis disease for plenti years but im condition be like say e don dey worse recently.

Public broadcaster NHK, tok say oga Abe wey be 65 years old no wan cause wahala for im goment.

Na since 2012, Oga Abe don dey for office of Prime Minister and earlier dis week, e become di longest serving prime minister.

Dis no be di first time wey dis sickness wey im don dey suffer since e be teenager dey affect im career, for 2007, dis same sickness make am resign from earlier term as prime minister.

Oga Abe dey popular as ogbonge conservative and nationalist, and say im grow di economy with im aggressive policy wey im call "Abenomics".

Why pipo dey worry?

Well pipo start to dey worry afta im enta hospital two times in one week weda im health don dey shake. E suppose serve for office till September 2021.

E neva tok why e go di hospital but tori be say for one of im visit, e stay for hospital for almost eight hours.

Although officials from im ruling Liberal Democratic Party (LDP) and im aide don tok say im no go step down, rumours still dey run about how oga Abe dey weak even as approval rating for im cabinet det reduce ova di way im dey handle di coronavirus pandemic.

Shinzo Abe

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Fear on top im health start afta e enta hospital two time for one week

Wetin go happun if oga Abe no fit work again?

For Japanese law, dem go get acting prime minister and time limit no dey as to how long e fit stay.

Deputy Prime Minister Taro Aso, wey be also finance minister, na first on line followed by di Chief Cabinet Secretary Yoshihide Suga.

Wetin go happun if oga Abe resign?

If oga Abe resign, e go trigger vote within im party LDP to replace am as presido.

Afta dat, parliament go come vote on top who go be dia new prime minister.

Dis prime minister go come hold di office until di end of oga Abe tenure for September 2021.