You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos govt. 'poverty head count' survey for 2020 go last for 25 days
Di Lagos State goment for Nigeria commercial capital city, say dem wan use 25 days to know who and who poverty dey worry inside di state.
Di goment comot dis ontop dia Twitter handle for one public notice wey dem call "Year 2020 Poverty Head Count Survey".
According to di notice, di survey - wey be questions to gada data - go reach select houses inside all 57 Local Goment/Local Council Development Areas for di state.
Lagos State say di data wey dem gada go epp dem sabi how pipo poor reach, know how to package resources to reduce poverty and to torchlight if dia "investments to assist di poor" dey work.
So how dis survey go work?
No oda informate on di poverty head count survey dey apart from wetin di goment write put inside di public notice. But dis na wetin we see:
- E begin on 17 August, 2020 and e go last for 25 days
- Officials go dey go pipo house to ask kweshions
- Di goment expect residents for Lagos to ansa di kweshions in truth
- Di goment no go use anytin (informate) wey pipo tell di officials to take nack dem tax
Which kain kweshions dem fit ask for di survey?
Di BBC never torchlight any sample questionnaire for dis poverty survey, but di federal agency National Bureau of Statistics (NBS) bin do one survey ontop Lagos many years back.
NBS publish di kain kweshions dem ask Lagasions inside one document ontop dia website; Di ones wey Lagos go ask no fit dey too different.
- How you dey take cook, wash cloth and iron?
- Who suppose pay for health/education/post office service?
- Wetin be di average total money wey your household dey make per month?
- How many pipo dey live for dis house?
- Which kain transport you dey use?
Di last report wey Lagos State do ontop poverty mata na for 2014 and e dey available on di goment website here.
End of Di one wey oda users dey read well well
Also, di goment no explain how dem take select which house dem wan go to ask how poverty dey worry dem.
Poverty na growing issue not just for Lagos but for di kontri of Nigeria. For 2019, UK charity Oxfam comot one report wey torchlight say di five richest pipo for Nigeria fit end poverty for di whole West African nation.