Taylor Swift £23,000 dash money 'shock' di girl wey collect am

Taylor Swift and Vitoria Mario

Wia dis foto come from, Getty Images/Vitoria Mario

Wetin we call dis foto, Taylor Swift don sell more than 50 million albums and 150 million singles worldwide

In dis age of "giveaways" wey celebrities dey do, one 18-year-old girl fit say luck don shine on am, afta di US ogbonge musician Taylor Swift, bless her wit £23,000, out of nowhere.

Vitoria Mario, bin start online fundraiser on 1 August afta she look right, look left, see say she no go fit afford money to use go school.

But no how wey she go sabi say 20 days later, from anoda continent, all di remaining money of her 40,000 target, go come from Taylor Swift, di American superstar.

Swift write: "Vitoria, I manage see your tori online and your passion and dedication inspire to support you to turn your dream into reality.

"I want dash you di rest of di money you dey find. Good luck wit everytin you do! Love, Taylor."

Ms Swift donate £23,373 to Ms Mario ontop GoFundMe

Wia dis foto come from, GoFundMe

Wetin we call dis foto, Ms Swift donate £23,373, wey be di exact money to complete Ms Mario target of £40,000 at dat time
Vitoria Mario
Wetin we call dis foto, Vitoria Mario say she wan thank Ms Swift "with all my heart"

Ms Mario wey bin wan read math for University of Warwick, react say she 'shock' well-well, as she promise to finish with top marks so as to "make Taylor proud".

"I no even sabi wetin to do. Even di message [wey Taylor write] dey very nice.

"How [Swift] take see my [gofundme], I no know. If to say na pesin from di UK, e no go surprise me. I wan thank her with all my heart," di happy student bin tell BBC.

Ms Mario move come UK from Portugal four years ago, so she no fit collect maintenance loan or grant from di university or goment.

Vitoria Mario

Wia dis foto come from, Go Fund Me

Wetin we call dis foto, Vitoria Mario say she no sabi speak English when she first reach UK for 2016

Na Netflix teach me English

Di teenager, wey her mama still dey live for Portugal, tok say her family no get di money to support her and na why she go online to beg for di money for accommodation, laptop, textbook and pocket money.

She say even though she no fit speak English when she move to di UK for 2016, she finish her A-levels with two A*s for maths and one A for physics.

Di English wey she sabi, Ms Mario say she learn am "from Netflix".

Dis no be di first time Swift don use dash money to support pipo wey she no sabi.