Cama 2020: See wetin you need to know about dis law wey dey make Christian leaders vex

Plenty reactions don follow di Companies and Allied Matters Act, CAMA, 2020 wey Nigeria President Muhammadu Buhari bin sign into law recently.

Di President tok say reason why dem add and comot some things for di CAMA 1990 na to change and improve how business take dey happun for Nigeria.

Di Cama Act document wey get over 700 sections and several chapters explain di new way business go begin happun for di kontri. According to di law, e explain how different sectors go dey operate like di Corporate Affairs Commission, how to form company, how to register company, foreign affairs, promoters, membership of di company, share capital, directors, protection of minority against illegal and oppressive conduct, financial disclosure and plenty oda things.

As some hail di law as good development wey go make am dey easy to register and do business for di kontri, others especially church leaders tok say some section dey for di law dey illegal for di church.

Why di law dey make some church leaders vex?

For under di law, na di registrar-general of Corporate Affairs Commission (CAC) and one supervising minister go dey in charge of religious bodies and charity organizations.

CAMA give di commission power to suspend di trustees of any association or religious body and dem fit appoint interim manger or managers to dey run di affairs of di organizations if dem believe say magomago don happun wey dey against di interest of di public.

One of di religious leader to first kick against di CAMA 2020 na di Presiding Bishop and founder of di Living Faith Bible Church AKA Winners Chapel, Bishop David Oyedepo.

Bishop Oyedepo for one of im Sunday sermon bin question why dem go make di same law for churches and for companies. He say goment no get power to appoint pipo over di church as e describe di church as God heritage for earth.

Di Christian Association of Nigeria (CAN) also don reject di Companies and Allied Matters ASct, 2020.

CAN for inside statement wey di Special Assistant on Media and Communications to di CAN President Adebayo Oladeji sign according to Punch newspaper tok say di federal goment just declare war on di church if dem carry on to implement di law.

Di Christian body say section 839 (1) and (2) of di law wey give supervising ministers power "to suspend trustees of an association (for dis case, di church) and appoint di interim managers to manage di affairs of di association for some given reasons dey satanic."

CAN be ask some questions like "why goment go fit sack di trustees of church wey dem no contribute any money to establish, why political minister or just anybody fit be di final authority and manage anoda institution wey no be political, why e be say pesin wey no be Christian and dey head goment ministry na im go determine how to run church."

Dem want make di President carry di CAMA Act go National Assembly, make dem remove di section wey affect churches.