Nigeria army recruitment 2020: ‘Why I dey apply to join di force’

As Sabithu Sani pack im bags dey leave Dogon Ruwa village for Katsina state, northern Nigeria on di 12th of February 2020 di one thing wey dey im mind na how to come back as a powerful pesin to helep im pipo.
Im village na one of di places wey dey experience banditry and kill-kill wey dey trouble northwestern Nigeria and Sabithu wey dey stay with im uncle for Kano say im ultimate dream as Nigerian army start dia latest recruitment na to join dem and helep defeat di bad pipo wey dey disturb im state.
"For years now wetin dey my mind na to join army because I get personal beef with dis criminals wey disturb peace for my village." Di Hassan Usman Polytechnic graduate yan.
"We be village of farmers and pipo dey fear to go farm now because of wetin dey happun. I no fit count number of pipo wey I know wey fall victims to dis insecurity for my village and neighbouring villages in di last few years, dem plenty."
"I don tell my family say na army I wan join and dem agree to support me especially my uncle wey I dey stay with now, e tok say e go give me all di support wey I need."
Sabithu say e know say na matter of life and death e wan sign up for and yan say since e small e be pesin wey no get fear.
"After I read about di recruitment online I come dey see pipo dey write say dem neva ready to die so dem no go join. Assuming bandits dey disturb dia towns dem for no think so." Im tok.
Di 23 year old say wen e finish school last year, im dream na to stay village assist im old father for farm but insecurity no allow im plan work.
End of Di one wey oda users dey read well well
"My plan na to assist my old papa for farm den eventually get my own farm ,dat is before landing a job so as not to just siddon like that. But di insecurity come dey increase so tey we dey fear to go farm."
Di Nigerian Army officially open dia 2020 registration exercise web portal for pipo wey wan apply for Direct Short Service Commission and for Short Service Combatant commission on Wednesday, 19, August 2020.
Di Headquarter of di Nigerian Army wey announce am for dia twitter handle say di recruitment na online and registration go start immediately.
Di Nigerian Army add say di 2020 SSC Course dey open to to everybody wey be Nigerian by birth e no mata if di pesin na civilian military personnel wey still dey serve.











