You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Alexei Navalny dey Omsk for 'poison' - Wetin we know about di poisoning of President Vladimir Putin critic & Russia opposition leader
Russia opposition leader Alexei Navalny dey unconscious for hospital wit wetin dem suspect to be poison, na wetin im tok-tok pesin tok.
Di anti-corruption campaigner bin fall sick during one flight and di plane make emergency landing for Omsk, na wetin , Kira Yarmysh tok for Twitter.
She say dem suspect say dem fit don put poison inside oga Navalny tea.
Oga Navalny na strong critic of President Vladimir Putin.
For June im describe one vote on constitutional reforms as "coup" and "violation of dia constitution". Di law go allow Oga Putin to serve another two terms for office.
"Dis morning Navalny bin dey return to Moscow from Tomsk," na wetin Madam Yarmysh tweet.
"During di flight, im body begin do am one kain. Di plane make urgent landing for Omsk.
She add say: "We dey suspect say dem poison Alexei wit something wey dem mix inside im tea. Na di only thing im drink since morning. Doctors say poison dey work faster with hot liquid. Right now Alexei dey unconscious.
End of Di one wey oda users dey read well well
Madam Yarmysh later tok say Oga Navalny dey intensive care.
Dis her claims no dey verified yet.
Oga Navalny make name for himself by exposing corruption, im even call Oga Putin United Russia "party of crooks and thieves".
For 2011 dem bin arrest am and put am for prison for 15 days sake protest ontop vote-mago-mago by oga Putin United Russia party for dia parliamentary elections.
For July 2013 dem put oga Navalny for prison briefly onto embezzlement charges but many see di charge as political.