Evicted Big Brother Naija housemates: Kaisha eviction make fans want BBNaija to cancel dis new voting style

Kaisha join evicted Big Brother Naija housemates

Wia dis foto come from, BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, Kaisha na di fifth housemates to leave Big Brother Naija Lockdown house
Read am in 2 mins

How Kaisha join evicted Big Brother Naija housemates from di 2020 lockdown season of di Nigerian television reality series dey make fans vex.

Kaisha become di fifth housemates to leave di show afta Lilo, Ka3na, Eric and Tochi wey also don comot for di reality television show.

But wetin pain fans for Kaisha eviction na say na she get di highest votes among di bottom four housemates from di fans.

Among di 14 housemates wey bin dey up for possible eviction na Neo, Wathoni, Triktee and Kaisha enta bottom four with di lowest amount of votes from di fans.

Fans want make Biggie change dis method of eviction, say who chop last suppose carry im cross. Dem say dis voting style no make sense at all.

Kaisha join evicted Big Brother Naija housemates

Wia dis foto come from, BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, See di bottom seven wey fans vote

According to di ranking of di bottom seven housemates out of di 14 housemates wey bin dey up for possible eviction, Neo carry last followed by Wathoni, Trikytee, Kaisha, BrightO Tolanibaj and Vee.

How di fans react to Kaisha eviction

Belle no sweet fans at all most of dem dey para afta dem spend dia money vote, na housemates na im go decide who go leave di house.

How di Live Eviction dey work dis season?

Evicted Big Brother Naija housemates

Wia dis foto come from, BBNAIJA/TWITTER

Wetin we call dis foto, Ebuka Obi-Uchendu na di host of di show

Every Sunday di housemates go take part for di live eviction.

Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room.

Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house.

Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show.

Kaisha

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic

How di Eviction bin work for previous season?

Before now housemate dey nominate each oda for possible eviction, di housemates wey get di highest votes go face possible eviction on Sunday.

But di power to decide who go stay or go dey for di fans hands, and so di housemates wey get di lowest votes from di fans go leave di reality show.