You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lebanon explosion: Authorities stop 'injured' Nigerian domestic worker wey survive blast from leaving di kontri
Authorities for Lebanon don stop five Nigerians from leaving dia kontri ontop di evacuation flight wey goment bin arrange on 12, August, 2020.
One of dem na Nkiru Obasi wey come from Ebonyi state, South East Nigeria wey dey work for Lebanon as domestic worker.
Inside message she send to BBC, Nkiru wey injure for di Beirut blast wey kill more dan 100 pipo say dem lock her and four oda pipo inside room and stop dem from boarding di flight say dia madam report dem.
"We reach airport now to board flight goment arrange and dem say dem no go allow us go, 5 of us, dem say our madam report us because we comot from madam house. Dem say dem no go allow us, we don beg but dem no allow us, dem dey throway our tins."
"If you no hear from me again, know say dem don put me for prison, if you no hear from me, know say dem don collect everything from me and put me plus injury wey I get for prison." Nkiru tok.
Nkiru say she comot her madam house because she no gree pay her salary since.
Meanwhile di Ambassador of Nigeria to Lebanon Goni Modu tell BBC Pidgin say dem dey aware of di situation and dem dey try resolve am. Ambassador Goni wey say dis no be di first time dis kain tin dey happun say na dia madam/master report dem.
Di Beirut blast wey happun last week Tuesday kill more dan 200 pipo, more dan 100 dey miss and thousands don lose dia homes.
End of Di one wey oda users dey read well well
Sabi pipo say di explosion go further put Lebanon wey dey struggle economically in a tight corner and domestic workers go bear di brunt.