Facebook: Mark Zuckerberg net worth hit $100bn afta im launch TikTok rival

Facebook Mark Zuckerberg net worth

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Facebook chief executive Mark Zuckerberg

Facebook founder Mark Zuckerberg don see im personal wealth rise to $100bn (£76bn) afta di launch one new app for short videos.

On Wednesday, Facebook announce di US rollout of Instagram Reels, wey be rival to di controversial Chinese app TikTok.

Facebook share rise by more than 6% on Thursday. Oga Zuckerberg get a 13% stake for di company.

Im don enta club of fellow so-called 'Centibillionaire Club' wey get Amazon founder Jeff Bezos and Microsoft’s Bill Gates.

Facebook

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mark Zuckerberg

Facebook, Jeff Bezoz Amazon, Apple and Google dey among bi biggest companies wey benefit from di coronavirus lockdowns and restrictions as more people begin buy, watch entertainment and socialise online.

Oga Zuckerberg personal wealth din don already gain $22bn dis year, while oa Bezo own don grow by more than $75bn, according to Bloomberg.

Wetin we call dis Video, WATCH: Instagram rolls out its TikTok rival Reels
Mark Zuckerberg net worth

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, How Facebook founder see im personal wealth rise to $100bn

Wealth tax

US senator and former presidential candidate Bernie Sanders dis week reveal plan to tax wetin im call "over-plenty money" wey billionaires make during di pandemic.

Di “Make Billionaires Pay Act” go tax 60% of di money wey di billionaires make from di start of di pandemic until di end of di year.