Jeff Bezos net worth 2020 as billionaire, American business magnate and Amazon.com CEO break stock record in one single day for Bloomberg World's Billionaires ranked list history

Wia dis foto come from, Getty Images
Jeff Bezos add $13 billion to im net worth on Monday, dia na di largest single-day jump for any individual since dem create di Bloomberg Billionaires Index for 2012.
Amazon.com Inc. shares go up by 7.9%, di highest since December 2018 since di trend of internet shopping increase and e don go up by 73% dis year, Bloomberg dey report.
Bezos, di 56-year-old founder of Amazon and di world richest pesin, don see im fortune rise by $74 billion in 2020 to $189.3 billion, even as di US dey enta im worst economic downturn since di Great Depression.
Personally, Jeff Bezos don rich pass di market value of giants like Exxon Mobil Corp., Nike Inc. and McDonald's Corp.

Wia dis foto come from, AFP
Mackenzie Bezos, im ex-wife, gain $4.6 billion Monday and she go be di13th-richest pesin for di world.
Oda tech titans dey also enjoy some increase sake of lockdown, as pipo dey forced to stay for house and shop online, dis don help di boost
Facebook Inc. Chief Executive Officer Mark Zuckerberg don also add almost $15 billion to im net worth so far dis year, even as di company dey deal wit brands wey dey boycotting ads on di social network.









