Nasa SpaceX crew dragon splashdown video: Doug Hurley, Bob Behnken capsule land on top water

Read am in 2 mins

Two American astronauts don land dia space-plane for water wey make dem di first commercial crew mission to di International Space Station wey return to Earth.

Di SpaceX Dragon Capsule wey dey Doug Hurley and Bob Behnken land for di Gulf of Mexico, south of Pensacola for Florida Gulf coast.

One ship to enter di water to pick up di space vehicle and coment di men for water.

Di landing mark di first crew US water landing since di final outing of an Apollo command module 45 years ago.

capsule of Hurley and Behnken hit di water at about 14:48 EDT (19:48 BST; 18:48 GMT).

Dem bin ask private boats wey come close to di Dragon to leave sake of concern say e fit dey commot dangerous chemicals from im system.

Nasa administrator Jim Bridenstine say di presence of di boats "no be wetin we dey expect ".

" Wetin no dey common na to have passerby come close to di vehicle wey get nitrogen tetroxide in di atmosphere; dat one no be sometin wey good" im tok. "And we need to make sure say we dey tell pipo say make dem no near di spacecraft for future."

Dem bin share fotos of di boats for social media.

Wetin be di SpaceX Crew Dragon?

"Na truly our honour and privilege," Hurley say as di astronauts arrive home.

"On behalf of di SpaceX and Nasa teams, welcome back to Planet Earth. Thanks for flying SpaceX," SpaceX mission control respond to am.

President Donald Trump - wey attend di launch of di capsule on 30 May - salute im safe return.

"Thank you to all!" he tweet. "Great to have NASA Astronauts return to Earth afta very successful two month mission."

Na wen dem see di vehicle four main parachutes floating ontop di e Gulf of Mexico sea na im dem confam say di spacecraft survive e fiery return through di atmosphere.

Di parachutes den slowed di capsule from about 350mph (560km/h) to just roughly 15mph (7m/s) at splashdown.

Rigging na im dem use hoist di capsule out of di water and on to di recovery vessel. Technicians bin monitor "remnant vapours" around di spacecraft before dem open di hatch.

Medical staff check di men before dem use helicopter fly dem to shore.

Di astronauts' Dragon capsule launch to di space station at di end of May on Falcon 9 rocket, wey SpaceX bin supply.

Dem go now repair am and fly am again next year.