Megan Thee Stallion: American rapper Megan Pete wey cry for video tok say she no deserve for dem to shoot her

Wia dis foto come from, Getty Images
American rapper Megan Thee Stallion wey popular for Houston, US and wey im real name na Megan Pete don lash out to pipo wey dey spread fake news about her shooting wey happun on 12 July for Hollywood Hills, Los Angeles.
Di female rapper tok for one video wey she bin post on her Instagram page on Monday 27, July say pipo no take her shooting serious or dem dey mock her for it.
"E no be anytin for anybody to start to dey go about and make fake stories about,". "I no put my hands on anybody. I no deserve to get bullet." she tok
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
She bin dey give new informate about di gunshot wounds wey she bin get for leg and she call am "di worst experience of my life" as she dey cry for di emotional video.
"Dem shoot me for my two legs, and I gatz to do surgery to comot di bullets, and I dey very very afraid," di 25-year-old hip-hop star tok, as she dey comot tears for her face for di video.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di American rapper still neva name di person wey shoot am, as she bin dey refuse since when she first tok for public on 15 July say dem shoot am.
Police bin arrest one Rapper Tory Lanez, wey dey wit her on suspicion say im carri weapon on di day of di incident but con release am the same day after bail. Megan and Lanez dey inside car together after dem comot from one party.
For di video she bin post on Monday, Megan tok she dey lucky say di bullets no hit any bone and she tank her parents and grandmother wey don die.
End of Di one wey oda users dey read well well
"I know say my mama and my papa, my granny dey look out for me with di place wey di bullets bin hit at, e miss everything," she tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Megan Thee Stallion don see major rise for di rap and pop music scene, and she bin top di Billboard Hot 100 chart dis year with her remix of "Savage" wey she featuring Beyoncé.
She win best female hip-hop artist for last month's BET Awards and dem name am AP's Breakthrough Entertainers of di Year for 2019.
She bin also blow dis year with one big hit wey she call Savage.
Savage turn massive hit afta e start to trend for di app, TikTok and enter Billboard list afta Nicki Minaj and Beyonce chook mouth for di remix.











