Megan Thee Stallion: Her three funny sides wey you fit no sabi about American singer-songwriter and rapper

Wia dis foto come from, Getty Images
Megan Thee Stallion wey real name na Megan Pete be ogbonge American singer, songwriter and rapper.
Di award-winning 25-year-old musician wey begin rap wen she be teenager, bin first grab attention wen videos of her rap freestyle start to dey trend for social media.
She bin enta news recently afta she experience shooting wey make her wound for leg, tho she neva give plenti details of wetin really happen.
Dis na some tins wey you fit no sabi about di social media sensation.

Wia dis foto come from, Getty Images
Twerking land her inside trouble
During her first year for Prairie View A&M University, Houston, she and her two besties, Kelsey and Daren bin turn campus celebs sake of dia twerking videos wey dem dey always post online.
As dia popularity come dey grow, na so di tin catch di attention of di school authorities wey invite di three girls come for meeting.
Megan say di women bin dey para say dem no wan make dem wear bumshorts.
Inside di boardroom wey dem summon di girls, di disciplinary panel bin play dia twerking videos one afta di oda, come burst laugh. Dem ask Megan and her friends weda twerking na wetin dem want make pipo sabi dem for.
End of Di one wey oda users dey read well well
To settle di mata, di three girls gats write research papers as dia punishment.
She be shy girl before
Most pipo go surprise to find out say Megan wey dey always look like boss lady, dey very shy before.
"Believe am or not, I bin dey shy before", she tok for interview wit Rolling Stone.
"I bin no want make anybody know say I sabi rap. Even wen I reach college and I tell my best friend say I sabi rap, she go say 'OK, oya rap'. She go want make I rap and I no go fit do am. But one time, we go rap battle, I come begin rap... I bin get confidence for myself, but I no really know as pipo go take react."
Afta some years, Megan confidence begin see beta results as her freestyle come dey go viral.
She still dey go school
Even tho say she be music star, Megan still dey pursue her part time degree for Health Care Management, she no gree dropout.
"My grandmama go vex well-well if I just stop school now now," she tok. Her plan na to open 'assisted-living facilities' wen she graduate.
Megan dey currently attend Texas Southern University in Houston, Texas. She enta her third year of studying in September 2019.











