Godswill Akpabio NDDC: Meet di Minister in-charge of Niger Delta Development Commission

Godswill Akpabio NDDC
Wetin we call dis foto, Godswill Akpabio may determine who wins elections in the oil-rich state of Akwa Ibom

Di name of former Akwa Ibom govnor and current minister of Niger Delta Godswill Akpabio dey lead plenty tori across Nigeria as one corruption probe into im work don begin gada steam.

Afta panel wey lawmakers launch to torchlight how NNDC take spend money wey reach N40 billion within three months, oga Akpabio drop bomb on Monday 27 July when e accuse some lawmakers say dem sef collect contract from im commission.

But pipo fit no sabi who oga Akpabio be and how im rise to di position wey im be today. Many bin don call am godfather of Akwa Ibom politics - name wey im bin reject; while odas see am as ogbonge strategist.

Godswill Akpabio NDDC

Wia dis foto come from, Godswill Akpabio

Akpabio sharp-sharp biography

  • Dem born am for 9 December 1962
  • E complete im primary education for Methodist Primary School , Ukana, and from dia go Federal Government College, Port Harcourt, Rivers State for im O' and A' levels certificate.
  • Study Law for University of Calabar and attend Nigeria Law School for Lagos
  • E do work as teacher and for small time practice for Paul Usoro and Co. wey be law company
  • Work for EMIS Telecoms Limited wia im become company Managing Director
Grey line wey dey
Grey line wey dey
Godswill Akpabio NDDC

Wia dis foto come from, Godswill Obot Akpabio

Wetin we call dis foto, Godswill Obot Akpabio

Akpabio inside politics

  • 2002 - Dem appoint am Commissioner for Petroleum and Natural Resources
  • 2007 - Become Akwa Ibom State Govnor under Peoples Democratic Party (PDP) ticket. Enta for second time for 2011
  • 2013 - Chairman PDP Governors Forum
  • 2015 - Win Senatorial seas of di Akwa Ibom North West Senatorial District (Ikot Ekpene)
  • 2015 - Senate Minority Leader
  • August 2018 - Senator Akpabio resign as Senate Minority Leader and port to All Progressive Congress
  • July 2019 - President Muhammadu Buhari nominate am for Minister for Niger Delta Affairs. Senate confam am di following month for August 2019
Grey line wey dey

For 2019, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin investigate oga Akpabio ontop alleged N100 billion (N258 million) fraud during im 2007 to 2015 time as govnor, although di corruption police no file any criminal charge las las.