Nanabaa: Ghana community for Kafaba lynch 90-year-old woman who dem accuse of witchcraft

Wia dis foto come from, Afia Pokua/Facebook
Di Murder of one 90-year-old woman wey fetish priest and community members allegedly kill over accusation of witchcraft make Ghanaians bore.
De fetish priestess, accuse de old woman, Akua Denteh of witchcraft after which dem torture am for hours which lead to her death, for Kafaba which dey around Salaga.
Viral video which dey circulate show how dem surround de old woman, dem use objects knock en head, slap am, whip am several times as she dey sit on de ground until make unconscious den later die.
How de lynching happen
De incident happen for Kafaba, community wey dey inside de Savannah region last week Thursday.
Reports be say dem carry de woman go house wey dem dey host de fetish priestess.
De fetish priestess do some chanting wey she reveal say de woman be witch, after that dem subject am to torture.
In de video wey dey circulate, you go see as woman wey take objects hit de woman en head whilst another woman dey use whip lash am.
After de beatings, she go unconscious wey dem give am concoctions to drink, dem carry am go en house where she die for.
End of Di one wey oda users dey read well well
Police for Kafaba carry de woman en body wey dem deposit for Tamale Teaching Hospital morgue for autopsy.
Who be de 90-year-old woman?
En family originally dey come from Kafaba, Madam Akuah Denteh be second born of 8 children
After she marry, she give birth to seven kids out of which one die.
According to JoyNews correspondent, Isaac Nongya, she get two boys and four girls, de first born of de woman who still be alive chop 70 years.
De woman be farmer sake of she no go school plenty.
Ghana IGP order manhunt of de killers
Inspector General of Police, James Oppong-Boanuh send security team to de region to find de fetish priest and community members wey kill de woman.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
According to Police, dem dey on manhunt for de suspects, Hajia Filina who be de fetish priestess, one Aliu who be teacher, Bumaye, Ashley and Manafo who currently dey on de run.
Ghana Police announce GhC 2,000 reward for information wey go lead to de arrest of any of de suspects.











