Flight resumption and Nigerian coronavirus update: Aviation authorities release new list of airports wey don open for flights

Flight resumption and Nigerian coronavirus update
Wetin we call dis foto, All passengers must do scan to check dia temperature before dem go enta plane

Nigeria goment don release newly updated list of local airports wey dem go allow to operate domestic flights for di kontri.

For list wey di Federal Ministry of Aviation just announce, dem tok say dis na di latest approved airport as at July 24, 2020.

Di approved airports na based on inspection wey dem don do to make sure di Airports get safety measures wey dem don put in place to prevent di spread of coronavirus.

Federal goment lift di ban on domestic flights on July 8 after over two months of lockdown sake of di pandemic.

Flight resumption and Nigerian coronavirus update

Wia dis foto come from, Twitter/Fedreal Ministry of Aviation

Wetin we call dis foto, Airport wey go operate domestic flight across Nigeria

Na only two airports dem bin allow to operate for di first phase-Murtala Mohammed International Aiprt, Lagos and Nnamdi Azikwe International Airport, Abuja

International Flights Resumption in Nigeria

Wia dis foto come from, NCAA

On Saturday, July 24 dem add additional two airports to make di total number of airports wey fit operate domestic flights for di kontri to reach 14.

Benin Airport, Benin and Yakubu Gowon Airport, Jos na di latest to resume operation.