You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos Building Collapse: Authorities don rescue two pipo wey trap inside three storey building wey collapse for Ebute Metta
Authorities don rescue two pipo wey bin trap inside one three storey building wey collapse for Lagos Mainland south west of Nigeria on Friday July 24.
Na for Ebute Metta area for opposite di Health Centre along cemetery street di building collapse. Dem say dey don carry di two pipo go hospital wia dem dey receive treatment.
Lagos state emergency management agency, LASEMA tok tok pesin, Nosa Okunbor wey confam di incident for BBC say nobody die.
For statement wey LASEMA release, di pipo wey trap na one female adult and one girl and dem dey stabilized.
Dem tok say di 25 years old building wey collapse bin don dey show signs of distress for sometime now.
Dis building collapse dey happun just few weeks afta one three storey building bin collapse for Lagos Island wey kill three pipo for July 11.
Building collapse na something wey dey happun from time to time for di state.
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.
End of Di one wey oda users dey read well well